Tuesday, 5 September 2017

Dem don flog one fulani suitor to death for Katisna for one marriage competition



One man wey em name be Yari Inusa, don die while em dey competite for one lady hand for marriage.



Na for Durmin Biri village, wey dey Kafur local Government Area for Katsina state the mata happen.
Police source yan say Inusa as em dey participate for the Fulani Traditional game of  Sharo with another man wey em name be Ahmed Saidu on top who go marry one lady acquire head injury.

The traditional game be say two male suitors go dey flog themselve to marry one woman and na the person wey win between dem go marry the woman.

Inusa don first flog Saidu but when e be Saidu turn e go beat Inusa for em head wey no be the game rule as na for back dem dey beat each other.

Report yan say Inusa collapse after Saidu hit em head and die later from the injury.

 Katsina State Police Command spokesman, DSP Gambo Isah yan say: “Inusa’s father, Mallam, reported the incident to the police, leading to the arrest of Saidu.”

No comments:

Post a Comment