Saturday, 2 September 2017
Police place IPOB leader, Nnamdi Kanu under Surveillance
The Nigerian Police Force don place the leader of Indigenous People of Biafra IPOB, Nnamdi Kanu under surveillance. As report take talk dem plan this one to take make sure sey em no comot for Naija, wey go kon fit stop am from re-arrest once the Federal High Court for Abuja don grant the Federal government wish to revoke em bail.
Before the Minister of Justice and attorney
General of the Federation, Abubakar Malami, last week write application to the court dey ask make dem revoke Kanu bail. Federal government for the application talk say the secessionist group leader don flout em bail consitions plenty times.
Kanu for em reaction ontop the mater so talk say if anybody try to re-arrest am sey the person go die.
But, dem police still no bother about wetin em talk as dem don put am under watch to take make sure say em no run comot for the country once dem don revoke em bail.
Police don also increase the number of their officers for South East and South South regions. The move na to help prevent any breakdown of law and order ontop the threat wey the IPOB leader don threaten say em go scatter Anambra state November 18th governorship election if dem no try fight for the creation of Biafra.
Among the police officers wey dem don increase for the South South and South East na those wey dey for Counter-Terrorism unit, the Intelligence unit and the conventional policemen.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment