Monday, 4 September 2017

Pregnant woman snap maternity photo with 20,000 live bees




One mother of three wey dey expect her fourth pikin don snap photo with over 20,000 bees wey still dey alive.




Emily Mueller. wey be 33 year old from Ohio wey dey run one bee removal service with her husband, Ryan, decide to pose with bees for her maternity photoshoot after dem call dem to come comot bees from one nearby hive the same day wey dem plan to go do their photoshoot.

As Emily take talk, she feed the bees with sugar before the shoot so dem no go get hungry when she put dem for body.



As Emily take yan, she say;

“A lot of people think I’m insane but I’m so comfortable with bees, so it was never something I had anxiety about. The actual sensation felt pretty good: 

“Having them all on me was this clinging sensation. They all stick to you and they are very warm, so it’s almost like when a kitten is walking on you.” 




Although the bees sting am like three times whn she dey do the shoot but she say the thing worth the photo wey she take and she dey try give bees better reputation.

She say;

 “I just want to raise awareness about how gentle they are.”

No comments:

Post a Comment