Monday, 4 September 2017

Woman share video of housemaid wey steal about N5million with Rolex watch and Gold



Woman expose her house maid wey her name na Kumenu Tope Samenu from Cotounou after she steal from her.



As the woman narrate for the video, she say Samenu carry her spare key to take enter her room anytime wey she no dey to take steal her money. She talk say even when she get visitors, she go open the visitor box to steal the money wey dey there.

She say na August 17 dem employ Samenu and the dollars and pounds wey she steal don enter N5million.



She say her gold wey she keep also with her Rolex wrist watch she carry am.

Samenu open Skye Bank account totake hide all the money wey she steal inside.

She kon share the video to take warn people make dem dey careful if dem go dey employ people from Cotonou as house-help.

No comments:

Post a Comment