Friday 20 October 2017

Photos: Police arrest 13 Nigerian immigrants for Bangkok for illegal entry, overstaying and romance scam



Imigration Police on Wednesday morning, October 18, search one Bangkok Condominium mas dem round up 13 Nigerians for illegal entry and say dem overstay their visa and dem also engage for romance scam.



Pol Lt Genereal Sutthipong Wongpin, wey be the acting Immigration Bureau commissioner, lead the officers wey search six buildings of the condominium complex for Romklao road wey dey Klong sam prawet subdistrict of Lat Krabang district around 10am wey he take arrest them.

Sutthipong talk say police search the condominium after dem arrest two Nigerians last week ontop charges say dem conduct romance scam for Thailand. Information wey the two men give na em make the police conduct the search.

The Immigration officers see 19 Nigerians wey dey live for the condominium. Six of them unlawfully enter the country as five of them don overstay their visas.

Police also seize 15 passports, seven notebooks, 12 phones one tablet and nine passports from the suspects.

Two other Nigerians dey involve for romance scam and the two of them get Facebook accounts with another name kon use oyinbo men as their profile pictures.

No comments:

Post a Comment