Saturday 21 October 2017

Soldiers kill 20-year-old apprentice, four others injure for Lagos when dem dey raid

Nigerian Army personnel wey dem attach to Exercise Crocodile Smile II kill one Sadiq Ismaila, 20 year kon run with the dead body to cover up the crime.



Four others wey be Paul Abudu and Bridget Afolabi also get injury from the incident wey happen around 1:30pm, for Oniru Block Village, Lekki on Tuesday.

As information take gather, the soldiers enter the area with three armoured tanks and eight Hilux vans, on Sunday kon arrest 76 persons.

According to The Nation, the soldiers dey shoot anyhow wey kon make people for the area and workers dey run up and down for safety. Ismaila, wey dey pack block for the area run after he hear gunshots.

Dem handover 65 of the people wey dem arrest to Maroko Police Division, wey kon transfer dem to Lagos State Taskforce on Environment. Dem release others for army barrack where dem subject them to hard labour and allow them to sleep for open field.

According to one food vendor, Rosaline Adedipe, the soldiers shoot Ismaila, because he no gree stop when the soldiers tell am.

Abudu wey narrate part of the tori to told The Nation talk say em sef dey run like others before them kon fall.

He say some people dey the area wey dey deal with drugs.

The Block Village Chairman, Bola Ekundayo, when he dey react to the matter talk say make President Buhari and Governor Akinwunmi Ambode probe Ismaila death.

One lawyer wey also be President, Yoruba Council of Youths, Aremo Hassan vow say em go get justice for Ismaila, say em don dey compile evidence to take report the matter.

No comments:

Post a Comment