Tuesday 24 October 2017

Tanzania arrest 12 people say dem promote homosexuality

Tanzanian Police don re-arrested 12 people,wey  two South Africans and one Ugandan,dey among say dem promote homosexuality.  
 The 12 wey dem don arrest before for one hotel last week but dem later release dem on bail, onlyfor dem to arrest dem again over the weekend.
Dem currently dey Dar es Salaam’s central police station dem dey await legal charges.  
  Their lawyer Jebra Kombole yan say dem first arrest dem as dem dey sought legal consultation to challenge the government over their decision to restrict healthcare services to LGBT community members.

No comments:

Post a Comment