Tuesday, 19 September 2017
30 Journalist dey face trial on top failed Coup for Turkey
Thirty journalists and newspaper executives from one Turkish newspaper, Zaman Newspaper wey dem shut down for 2016 dey face trail wey fit lead dem to live sentence on top charges wey link dem to the failed Coup wey happen for Turkey.
Dem charge dem with “membership of an armed terror organisation” and sey dem “attempt to overthrow” the government, parliament and the constitutional order through their links to one cleric Fethullah Gulen.
Zaman dey affiliated with Gulen, U.S.-based cleric and former ally of President Tayyip Erdogan wey blame Gulen sey na em instigate the failed attempt for July 2016 Coup.
Turkey’s Justice Ministry for July don announce say dem don arrest over 50,000 people on top the mata and 169,013 dey face legal proceedings since the failed coup attempt don happen.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment