Wednesday, 27 September 2017
Kogi State Polytechnic student go on rampage as Dangote truck crush one of their students and 4 others to death
Students of Kogi State Polytechnic, Lokoja don enter the Lokoja-Abuja highway to take protest one of their colleawues wey Dangote truck crush to death.
Na five people die for the accident, one of the people na student of the polytechnic. Na this one vex the student wey dem kon start serious wahala for international market wey dey along Lokoja-Abuja Highway.
As report from some of the student take talk on Facebook, the Kogi State Plytechnic student wey the truck kill na female student. She wan cross the road dey go school for exam when the trailer brake fail kon go crush her.
See more photo for here:
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment