Tuesday, 26 September 2017
Last victim wey dey survive drunk police attack for Warri don die
The last surviving victims of inspector Samuel Imana and em team don die for Benin Teaching Hospital on Sunday.
Dem hire Inspector Imana and em team as escort to some men wey attend one pikin dedication for Warri, Delta State on September 17.
When the men start to dey spray money, the police inspector start to dey shoot for air but unfortunately the bullets go hit two people wey kill them.
When the policemen dey try to escape from people wey wan attack dem ontop the matter, dem still go use their motor jam another person wey the person land for hospital.
Them rush the victim to University of Benin Teaching Hospital where em dey unconscious until he die on Sunday.
The four police officers wey dey involved na Inspector Samuel Imana, Inspector Anthony Nwali, Sergeant Anthony Oniri and CPI Innocent Ajah, dem don arrest them and dem don charge dem to court for misconduct and murder.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment