Famous Nigerian music duo, PSqaure Don finally seperate after news say dem fight hit internet.
Na Peter first spark speculation say em and em twin Paul Okoye dey fight as he refer to em self Mr. P wey be em own personal brand name.
After that he share another post on top Instagram where e yan say other people opinion no mata a long say na wetin dey make you happy.
Although em no mention name, Paul reply say through of of em Instagram post,where e yan say birth of em twin dey make some people jealous and restless.
He kon further accuse the person say dem dey get sleepless nights, kon indirectly call out Peter's wife Lola - as e yan say;
"Only a woman can come where there's peace and destroy it. Try me this time, I swear Nyash go open. You will know that blood is thicker and stronger than juju."
According to report, Peter don sent termination letter to their lawyer Festus Keyamo (SAN), where e yan say e won terminate em Psquare agreement.
For the letter, he defend em decision as e yan plenty things against em twin Paul and older brother/group manager Jude.
According to Peter, Paul no won co-operate with am again, even as em go cancel their planned US tour wey dem won do this year without yanning am about am first and he (Peter) don try everything wey fit make dem work but all to no use.
Peter follow accuse Paul say em slander his wife and children with lies on top social media, and alleged say dem dey receive threatening messages.
He follow yan say em older brother Jude don once threaten say em go kill am kon shoot em wife Lola.
Na infront of Paul and former first lady of Cross River state Mrs Imoke e dey yan all this tori.
He also allege say Jude yan say e go bring coffin for am (Peter) if he come to em house house.
Peter kon yan say everything don tire am and e wants out of the Psqaure group and contract.
The singer yan say e still love em brothers and their families, and he wishe them the very best for their careers but e no fit betray em wife and children as dem dey important to am.
No comments:
Post a Comment