Friday, 22 September 2017

Uber don loose em licence to dey operate for London




London transport authority don declare Uber unfit to operate for England.


Na Transport for London (TFL) announce the tori today and the reason dem give be say Uber dey unfit to operate because of public safety and the kind way dem dey report criminal offence.

'TfL considers that Uber's approach and conduct demonstrate a lack of corporate responsibility in relation to a number of issues which have potential public safety and security implications.' 

Dem submit 100,000 signed petition to TFL say make Uber improve their workers right or make dem comot from London before the licence decision.

After their current licence expire for September 30, dem no fit operate for London again.

No comments:

Post a Comment