Na like 2,000 villagers won sue mining giant Vendanta for one UK court.
The villagers wey dey stay for Nchanga for the country copperbelt province dey sue for injury and damages to their property on top wetin dem tak say e plenty and the thing dey bring toxic changes around where dem dey live.
Vendata Resources get asset base of almost $40bn wey spread across the world and their Zambian subsidiary konkola copper mines (KCM) don appeal against one ruling around May 2016 when one high court judge decide say the claim fit proceed.
KCM wey employ 16,000 people for Zambia don won make the claim hearing happen for the country but Reuters report say the judgement go play significant role to define the future liability of the multinational companies wey base for UK for allege human rights and environmental abuse outside the country.
No comments:
Post a Comment