Tuesday 21 November 2017

Four men die after dem drink local gin 'ogogoro' for Imo State

Four people don die for Imo state after dem drink locally-made alcohol, wey people know as Ogogoro

The incident happen for one popular drinking joint for Imerienwe community,wey one Uwadiegwu Eze own, for Ngor-Okpala local government area of the state last week.
 Agbara Emma, a community leader, yan say the victim start to dey complain of stomach pain few minutes after dem take the drink and that the story change by Saturday. 
He give the names of the people wey die as Chibuzor Nwosu, Ifeanyi Nkwocha, Ada Danganerand Friday Osuji.

No comments:

Post a Comment