Wednesday 20 December 2017

Facebook go now alert you when friend upload photo of you even if dem no tag you

Facebook go now send alert any time dem upload a photo of you on top the social network even if dem no tag you for am . 

The company don dey use facial recognition since 2010 to suggest people wey dem tag for photo.

Now, it fit identify your face, dem go send you  notification when it spot you for any shot. 
Na only photo wey allow this feature for em privacy settings go get notification.  

The move dey intended to prevent impersonation, a widespread issue on top social media sites.
 In India, the company don test the feature to fight the issue by blocking user from downloading profile picture to pretend say dem be someone else.

"Our goal in building these features is really to empower people and help them manage their identity on Facebook," Rob Sherman, Facebook's deputy chief privacy officer yan.

No comments:

Post a Comment