Wednesday 21 February 2018

94 school girl don dey missing after Boko Haram attack one all girl school for Yobe

94 student for Government Girls Science and Technical Secondary School wey dey Dapchi town for Bursari local government area of Yobe state don dey missing after one attack from Boko Haram on Monday February 19th. 

According to report say the parents of the students for the school do joint head count with teacher for the boarding school yesterday kon discover say 94 of the student don dey missing.
Initially report dey say the teachers and the girls for the hostel, dey over 700 in number, run enter bush when they hear the gunshots of the sect members. 
Howevere, after the headcount on Tuesday, dem discover say at least 94 of the girl still dey missing. The school don immediately close down as education authority and security force for the state don start effort to locate the missing students.

No comments:

Post a Comment