Monday 11 September 2017

21-year old beauty therapist don yan say she sleep with Amir Khan after em public breakup with em wife Faryal



One beauty therapist wey her name be Emily Volkova wey come from Crawley, Sussex don allege say she sleep with Amir Khan few days after he dey accuse em wife Faryal say she dey have affair with British boxer Anthony Joshua.




According to report, Emily yan say em ditch her after dem share passionate night.

"I’ve learned the hard way that he’s just a player – a love rat, if you want."

Emily wey be Muslim convert yan say she message Amir after em announce say he don divorce em wife because say she dey cheat.

She yan say Amir give am em number kon arraign to meet am for one hotel wey dey close to Heathrow before em go watch Mayweather and McGregor clash for Las Vegas.

The beauty therapist yan say after dem have sex, he kon offer am £20 for a McDonald's but she turn down em offer.

She yan say after em come back dem talk about em marriage wey don crash but watin shock her be say Amir turn nasty kon make am clear say na just one night stand dem do.

“The abuse he gave me when he made it clear the one night we spent together was all it was showed him up for the horrible piece of work he is.

“Calling me a ‘daft white slut’ and ‘dirt bag’ was really uncalled for. I would never have ­spoken about him if he hadn’t turned that nasty.”

No comments:

Post a Comment