Monday 11 September 2017

'He choked to death after swallowing packets of drugs with beer' - Police yan on top Nigerian man wey die for South Africa



The death of one 36-year old Nigerian man Vryheid, don take another turn as people dey allege say na Xenophobic attack.



Nigerians claim say Police torture kon suffocate Kingsley Ikeri to death as dem dey conduct drug raid for August 30.

According to one Emeka wey be friend with Ikeri and dem arrest dem together, he yan say Police carry am go em house kon put plastic to cover em face, handcuff em hand and legs for like over one hour thirty minute.

As Okoye dey yan Channels Television on top this mata, ye yan say em never witness anything like that before for em life.

He kon yan say:

“Even now, if I cough, I cough out blood,”

But na another tori  the investigating team for Ulundi Police station yan.

Dem yan say dem arrest Emeka Okoye say em posses drugs and dem kon detain am.

They follow yan say after dem question am, he carry information give dem on top another drug dealer wey dey for East Street.

After dem carry Mr Okoye go cell, dem kon carry am go em house make dem search for drugs so dem fit arrest am.

Na for there dem find Kingsley Ikeri wey dem yan say swallow one substance wey dem no know with bear as dem approach am.

The police kon yan say after em swallow the substance e dey choke so dem kon carry am go Vryheid Hospital where he kon lata die.

No comments:

Post a Comment