Wednesday 13 September 2017

Dem don give MTN ultimatum say make dem shut down their Comedy+ platforms



CEO of Mayphem International Mr. Femi Edwards through em lawyer today don give MTN seven (7)days ultimatum say make dem shut down their Comedy+ platform because sey dem dey infringe on top em own brand.



Mr. Femi Edwards start em own Comedy+ Print media since 2009 and people don know am for Plenty state for Nigeria.

Em own Comedy+ platform dey organize plenty events for Lagos, Ogun and Cross River state for Nigeria.

For 17th March 2017, Telecommunication Giant MTN launch em own Nigerian Comedy platform wey dem call Comedy+, the platform na to promote comedy for Nigeria.

Dem launch the platform for Club Rumours wey dey Lagos where plenty important people for the industry come.

The platform don get plenty comedians wey dey use am and people wey like comedy sef dey use am.

Edwards own Comedy+ media get em online platform also and e dey under registered mark of Mayphem International.

Femi Edwards kon yan say Comedy+ be em own brand and e no go allow make MTN infringe on top em intellectual property.


No comments:

Post a Comment