Tuesday, 12 September 2017
Dem find Belgian Mayor, Alfred Gadenne dead body for cementry
Dem find City mayor, Alfred Gadenne dead body for Belgium Cementry where dem don cut em throat open.
Em death na shock for the people as the Prime minister dey yan on top the horror of em death.
Na em wife find the 71-year old mayor dead body for the graveyard wey dey close to their house.
Gadenne be the gate keeper and na em dey always lock the Mouscron cementry for every evening.
According to report, the suspect don hand em self to the police but em motive still dey unclear.
On top the mata, Prime minister Charles Michel yan say:
'I have learned with horror of the brutal death of Alfred Gadenne. All my thoughts are with his family and friends.’
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment