Dem save one 25 year old Chime Chinedu Afamefuna recently after he wan commit suicide as he drink rat poison for Uwani, Enugu State.
As tori take circulate, Dem see Afameduna when he sit down dey vomit after he drink the poison for inside one classrooms for Uwani Boys Secondary School on August 12. Members of the Enugu South division of Enugu State Command of the Nigerian Legion Corps of Commissionaires, see am for the unconscious state wey em dey.
The Divisional Officer of Enugu South Division of Nigerian Legion Corps of Commissionaires, Ekoh-Clement O.I. talk say em men dey the school premises for training when dem discover Afamefuna.
He say;
“After the field walkout and parade, they retired to one of the classrooms for briefing only to discover a young man whose name was later gathered as Chime Chinedu Afamefuna who left a suicide note, drank a poisonous substance, vomited all over the classroom and was sitting in the pool of his vomit. The officers quickly perused the suicide note and some men were sent to an address that was left on the note where a supposed relation by name Gloria Aneke can be found while the divisional officer alongside with two other officers rushed to Uwani Police Station. The DPO was not in the office so the officers met the DCO (Sp Okeke Chinedu) who responded quickly and sent some of his officers to join the legionaires who came to report the incident. The young man was later taken to the police command clinic where his life was saved,”
![]() |
Suicide note wey Afamefuna write |
Gloria Aneke wey Afamefuna mention inside the suicide note wey em write before he drink the rat poison na em auntie wey the both of them dey get issues because he dey always dey inside police case, Gloria na em dey take care of Afamefuna and em brother when em mama die wey be her own sister die.
The whole issue between dem start when Afamefuna start to dey follow bad boys up and down, as he no wan dey under her again he run comot for house go join the street boys.
Gloria wey feel sad for her nephew after she see the suicide note talk say she go take am back only if he go change em character.
Ekoh-Clement talk say according to information wey dem gather, e suggest say Afamefuna dey expose to cultism when he dey for streets and he fit decide to take em own life since he no fit live up to the demand of the cult group.
He say;
“The way he was dressed doesn’t suggest somebody finding the world very difficult because he was wearing good dresses,”
He say em last phrase for the suicide note “IN THE NAME OF FUTA-JALUN my mother high temple” fit get something to do with either mysticism or cultism.
The state police command talk say dem done start investigation ontop the matter say Afamefuna fit get deep rooted issues wey force am to wan take em own life.
No comments:
Post a Comment