Wednesday 13 September 2017

EFCC don discover another asset wey belong to Patience Jonathan for Abuja



Operatives for the Economic and Financial Crimes Commission EFCC don discover two more assets for Abuja wey belong to former first lady, Patience Jonathan who dem still dey investigate say she dey involve for Money laundry.



According to report dem believe say the asset wey dem just discover na the former first lady get am and she buy am with the money wey she get from her three firm wey the name be Ariwabai Aurera Reach out Foundation; Finchley Top Homes Limited; and AM-PM Network Limited, wey dey under investigation for corrupt practice.

Na like 15 properties dem don discover now for her name wey dem dey investigate.

No comments:

Post a Comment