Wednesday, 20 September 2017
Police don arrest one Texas woman wey kill her boyfriend as e dey sleep kon cut em body to pieces
The Baytown Police Department for Texas don charge one woman say she murder her boyfriend.
Police yan say 30-year-old Cierra Alexis Sutton shoot her boyfriend, 32-year-old Steven Coleman as em dey sleep kon cut em body to pieces inside em apartment complex wey dey Houston suburb of Baytown.
Some of Sutton friends yan say she confess say her ten year-old daughter dey there as she dey kill her boyfriend.
According to report, she and boyfriend argue for evening, later when her he dey sleep she shoot am kon use cutlass cut em body to pieces, rap am for sheet and duct tape kon dispose am for dumpster.
Na Sutton go police station on August 18 go report say her boyfriend Coleman dey missing for the past two days and say em leave house around 10:30pm.
Na later after investigation ans anonymous tip dem discover say na she kill her boyfriend and dem kon arrest her as she dey try run away with her daughter for New Orleans suburb.
No comments:
Post a Comment