Police don identify one school teenager wey stab em class mate to death on top say e no give am biscuit as Daniel Stroud wey come from Aberdeen, Scotland.
Na the same day wey he turn 18 dem uncover em identity after dem put restriction on top em report for two years.
Na for Cult Academy, Aberdeen em stab em 16 year old class mate Bailey, for heart on top say em no give am biscuit chop.
During em murder trial for 2016, Stroud yan say dem dey always tease am sey em fat na why he carry weapon go school make em try impress other kids wey dey em school.
He follow yan say em no fit in for school and em dey only try act cool.
No comments:
Post a Comment