Friday 20 October 2017

Dem burn suspected "vampire" to death in Malawi



Dem beat, kon use fire burn one young man for Malawi wey dem dey suspect say em be vampire and he dey suck blood near Blantyre.





According to journalist Lucy Ashton, dem see am for one graveyard near one main road outside the city of Blantyre kon take am go police station on Thursday.  e be like say he dey suffer from mental illness or epilepsy as he dey carry one health card and and e fit be say na from hospital e dey come from.

Some people wey hear about the "vampire" rumours invade the police station kon drag am outside to kill am. Em death kon bring the number of those wey dem don kill ontop say dem dey suspect say dem be vampire to eight since September. 

Clinical psychologist Chiwoza Bandawe, from the University of Malawi, explain say

 'given the fact that we’re conservative and generally superstitious or a culture that believes in mysterious magical explanations for things then people will tend to attribute their difficulty on what they call blood suckers. It's almost a symbolic representation of the life, their blood, their hope being drawn out of them, being sucked out of them'.

He say tragically na people with mental health problems dem dey target.

No comments:

Post a Comment