Dem don arrest one South African female police officer ontop sey dem see drugs with am for Sao Paulo International Airport for Brazil.
Dem arrest Angela Maluleke wey be 33 from Giyani for Limpopo as dem see am with six bricks of cocaine for her load.
As International Relations Department take talk, dem en route the officer to Johannesburg where dem kon handcuff am.
Police Minister Fikile Mbalula spokesman Vuyo Mhaga talk say the ministry dey very disappointed by the arrest because the thing spoil the image of the police.
He say but dem dey pleased say na Interpol Sa with Brazilian police arrest am.
One source wey dey close to the department yan Sowetan Live say the South African Authorities dey very puzzle ontop wetin Maluleke dey do for Brazil.
No comments:
Post a Comment