Thursday, 31 August 2017

See photo of the woman wey drown for Texas flood when she dey try save her daughter


Dem don identify one mama wey drown for inside the flood wey happen for Texas as Collete Sulcer.

The strong current of the flood sweep the 41-year-old woman for the Texas flood when she dey try carry her daughter Jordyn go where she go dey safe.



Rescuer see the little girl alive as she dey hold her mama dead body.

As reports take talk, this matter happen after the mama hook for Beaumont as she dey try run from the water wey dey increase inside her motor when the Tropical Storm Harvey happen.

Police talk say Collete try hard to keep her pikin head above the water. When dem see her half mile from the scene. Jordyn still dey hold her mama body wey dey foat ontop water already.



Carol Riley, one spokesperson for Beaumont Police Department talk say she save the pikin life.

She say,

‘They were in the water for quite some time. The mother did the best she could to keep her child up over the water.
‘The baby also had a backpack that was helping her float on her back and she was holding on to her mom.’

No comments:

Post a Comment