Thursday, 7 September 2017

Dem don accuse South African Police say dem kill one Nigerian man




Family members of one Clement Ofoma, don accuse Sout African police sey dem tortue the 35-year old Nigerian to death.



According to wetin the family members yan, dem yan say 10 South African police go Clement shop wey dey Springs town wey dey near Johannesburg for Tuesday, September 5th, kon arrest am sey he dey traffic drugs and substance wey government don ban.

Clement wey be native of Obosi, Idemili North local government area of Anambra, deny all the allegations wey dem yan say em do. While he be dey resist arrest, the police officers kon use cellophane bag cover em face.

As he dey struggle to breath, he collapse kon later die for hospital.

The Nigerian community for South Africa don condem the killing as dem yan say such incident don dey too happen to Nigerians wey dey South Africa now.

No comments:

Post a Comment