Thursday, 7 September 2017

Hurricane Irma don destroy 95% of the building wey dey Barbuda Island




Hurricane IRMA don affect Puerto Rico for like 24-hours ago with heavy rain and powerful wind wey don affect like 900,000 people, as dem no get light and the authority wey dey the state dey try struggle make dem get aid to the small Caribbean Island.



Na almost all the building wey dey Barbuda island the storm don affect kon leave like 1400 people no wey no get house.

Antigua and Barbuda Prime Minister Gaston Browne yan Associated Press say:

"Either they were totally demolished or they would have lost their roof. It is just really a horrendous situation."

He follow yan say one 2-year ld pikin die as the family dey try escape their house wey the storm don damage.

The U.S. National Weather Service yan say Puerto Rico never see hurricane wey big like this since 1928, wey Hurricane San Felipe happen wey kill 2,748 people for Guadeloupe, Puerto Rico and Florida.

No comments:

Post a Comment