Kris Jenner only male pikin, Rob Kardashian, don accuse em baby mama and former fiance, Blac Chyna say she beat am kon try to choke am while she dey high on alcohol and drugs, last December.
According to a lawsuit filed by, Rob K against Blac Chyna, he claim say Chyna first tried to choke am with iPhone charging cable, kon give am plenty blow on top em head and face.
According to the lawsuit:
"Chyna lunged towards Rob with an iPhone charging cable and attempted to strangle Rob," the lawsuit states. "Chyna was purposely trying to hurt Rob and struggled with him as she tightened the iPhone cord around Rob’s neck."
He follow claim say she destroy em, as she brake em door, damage walls and TV and everything kon worth like $100k.
He talk say when e try say make e run away from the violence and enter em Bentley to drive away, Chyna throw chair at em car, kon use metal rod to hit am.
Rob kon yan say e manage to escape Chyna, but she still continue to dey pursue am.
He claim say she hit am for em head and face more than one time, kon rip em collar of em shirt.
Kylie Jenner be co-plaintiff for the case because the mata happen for her house wey she rent out to her brother, Rob and the TV wey Chyna broke, be Kylie own.
"Kylie estimates that Chyna caused at least $100,000 in property damage to her house".
No comments:
Post a Comment