Monday, 25 September 2017

Thieves don break into Jason Derulo mansion,dem steal jewery and cash



Thieves break into Jason Derulo Los Angeles mansion and dem steal $300,000 worth of cash and jewelery. 
Dem no quickly discover say thieves enter the house as the singer no dey house, na one of em staff wey go em house on Friday find out.

According to report; the maid realize say someone don enter and steal some things after she see say dem don break one window and door for the house. 

Dem call  Police to the house and dem report say thieves come the place but dem dey wait make Derulo come back home make e come identify wetin dem steal.

Police dey suspect say na inside job because na only one room dem target for the house.  

No comments:

Post a Comment