Wednesday, 4 October 2017

Ex-employee of Gucci don sue dem for Sexual harassment

Chanel Falasco, wey be ex-employee of Gucci dey sue the giant luxury brand on top say her manager for the downtown Chicago store go their storage room kon pull out em penis at her.

According to the suit, she allege say he also bombarded her with crude comment about her ass kon  give her the nickname "booty." 
For the document wey TMZ obtain, Falasco yan say the manager try to kiss her kon grab her by the neck, torso, and ass. 
She claim say for 2015 she dey mortified when e pull down em pants for the storage room kon tell her say make  perform oral sex on am or "at least just touch it."
According to Chanel, she complain to a higher-up, but Gucci no do enough to address the matter  especially because dem know say the manager don behave inappropriately with other employees before.
The lady dey sue the fashion brand for unspecified damages.

No comments:

Post a Comment