Wednesday 11 October 2017

Lionel Messi send Argentina go World Cup 2018 with em goal against Ecuador

Lionel Messi be the hero for Argentina as the striker score hat-trick goal against Ecuador on Tuesday to take seal their spot for next year World Cup in Russia.

Argentina, wey win the World Cup twice for 1978 and 1986, dey close to missing out of the 2018 World Cup after dem start the match in sixth place for the South American qualifying group.
The match wey happen for Estadio Olimpico Atahualpa in Quito, saw the host stun Argentina as dem score after just 38 seconds wey the match start as midfielder Romario Iborra hit on target.
Lionel Messi sends Argentina to World Cup 2018 with magnificent hat-trick against EcuadorBut thanks to Argentina captain, Messi, wey do em magic with an equaliser for the 12th minute kon score another for the 20th minute, em 20th goal for his country for World Cup qualifying wey also be South American record.

No comments:

Post a Comment