Thursday 12 October 2017

Police re-invite Davido for questioning after autopsy show say na suffocation kill Tagbo

For one press conference wey happen yesterday, Lagos State Police Commissioner, Imohimi Edgal yan on top the death of Tagbo Umeike kom announce say dem don reinvite Davido for questioning. 

According to the commisioner, Davido yan say na one of em friend inform am say Tagbo don die while em dey DNA night Club. 
Further investigation by the police show say na Davido driver (Tunde Yusuf) and two of Em friends carry Tagbo go hospital.

The commisioner follow yan say during the investigation, Davido driver yan say na em tell dem say make dem carry Tagbo go General Hospital and autopsy report show say na suffocation kill am.

According to the Commissioner, the CCTV footage from the lounge where he drink (Shisha Lounge) for Lekki show say Tagbo drink up to 40 shots of tequila.

 The footage also show say e start to dey cause trouble and show violence. 
 The ash colloured corolla wey dem use carry Tagbo go the hospital, Police don see am for Davido house wey dey Awosike street Lekki phase 1, Lagos.

No comments:

Post a Comment