Wednesday 21 February 2018

Lagos State don jail 13 cart pusher

13 cart pusher don dey sentence to five month imprisonment by one Magistrate Court wey sit for Ogba, Lagos State, say dem violate the state environmental law. .
Na Lagos State Environmental Sanitation Corps arraign dem on Tuesday, after dem arrest dem for Lagos Island, Ikorodu and Egbeda. .

The magistrate, Ogundare Olayinwola, wey deliver the judgement, sentence the men go five month imprisonment but she kon give dem option of N20,000 fine

No comments:

Post a Comment