Wednesday 13 September 2017

Eedris AbdulKareem yan say na em beef with 50 Cent earn Nigerian artiste respect for all country



Veteran rapper, Eedris Abdulkareem don speak on top em beef with American rapper 50 Cent.



Na like 13 years ago wey Eedris confront 50 Cent for Lagos airport, na when 50 Cent suppose headline Star mega jam the beef start on top ADC airline wey dey carry dem from Lagos go Port Harcourt.

Report yan am say Eedris won sit down for the sit wey dem keep for 50 Cent but dem no allow am.
According to reports, the rapper yan say he dey try protest the treatment wey dem always give international artist over local artist, he follow yan say na the beef wey em start gain respect for Nigerian artist for everywhere for the world.

Eedris yan say:

 'When I was on the plane with 50, and he asked me to get the hell out of his seat. I said no, this is Nigeria, this is my country'.

'He can't come here and tell me sh*t, that isn't gonna happen. That was the revolution that got every artistes respected in the Nigerian industry and it took them all over the country.'

'That was the defending moment for the Nigerian artistes, I can remember at the back stage, Psquare was sent away, a couple of people were also sent a way and I wasn't happy about it.'

'But moving forward, I'm happy for the Nigerian Industry and am happy with everything that's happening today.'

Na 3-years later dem settle the beef when 50 Cent come perform for KORA media launch Award for Abuja, na Eedris publicly apologize to 50 Cent.

No comments:

Post a Comment