Wednesday 13 September 2017

One 19-year old boy don kill em mama on top dog mata



One Michigan 19-year old boy wey em name be Andrew David Wilson don kill em mama few hours after she tell am say he no fit keep the dog wey em carry come home few weeks ago.



Dem don arraign Wilson for court on Monday on top the mata and dem charge am with murder and felony firearm possession.

Police find Andrew mama wey her name be Lisa Marie Wilson, 51-year old for her bedroom for her house wey dey Williamston, Mich., for Wheatfield Township.

Na Andrew call police after he kill em mama, kon lie say he come home  see say dem don murder em mama after e go for one drive go Ingham County (Mich).

Na the Sheriff detective kon yan the judge watin em yan when he call the police, na watin kon lead to charges against the teenager.

Magistrate Mark Blumber don deny bond for Wilson who don dey police custody from Friday.

Police yan say na once and for the back of her head Wilson shoot em mama.

Detective Charles Buckland kon testify say nobody apart from Andrew and em mama dey house for the night wey the mata happen.

Buckland follow yan say Andrew follow em mama talk on top the puppy mata for thursday evening and she tell am say em go take the dog go em papa house.

Andrew kon yan say na for night em comot the 22 Magnum rifle wey dey lock cabinet kon go em mama room shoot am for head as she dey sleep.

He follow yan say after em kill em mama he kon drive around small dispose the rifle. The police don recover the weapon which dem yan say get spent shell casing.

No comments:

Post a Comment