Friday, 8 September 2017
We killed Imo catholic priest in error- suspects yan
The police for Imo state, don parade five people wey dem suspect sey kidnap and kill one prist, Cyriacus Onunkwo, for the state.
One of the suspect be police officer, na Friday September 1st dem kidnap the priest and dem kon later find em body for Orlu wey dey along Omuwa road for saturday, September 2nd.
One of the suspect wey dem parade yan say na through error dem kill the priest.
He yan say:
“When we kidnapped the priest, we used cellotape to seal his mouth, unknown to us, his nose was also sealed. When we discovered that he could no longer talk, we unsealed his mouth and found out that he has dead".
Police still dey investigate the matter and dem go soon charge dem go court.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment