Tuesday 10 October 2017

Dem arrest Two Policemen and One Naval officer wey won kidnap one five-year-old boy

Dem arrest two serving policemen with one naval personnel and three other suspect wey try kidnap one five-year-old boy for Ayangba, Kogi state and dem dey among 18 kidnap and armed robbery suspects wey dem parade before journalists for the Kogi state Police Command on Monday.  

Ali Janga, the state Commissioner of Police for the parade in Lokoja, identify the policemen as Cpl Suleiman Isiaka and Cpl Ibrahim James while the naval personnel be Ordinary Seaman Bature Habila of the Western Naval Command.  

Janga yan say the suspects enter the state with charter commercial bus wey one Daniel John wey dey police custody drive.  Janga yan say na 100,000 dem be won pay John for em service. 

The Commissioner follow yan say na hotel room wey dey Ayangba dem arrest dem before dem fit carry out the operation.

 According to Janga, na 11 rifles, wey four AK-47; three pump action; four pistols; hundreds of magazines and a bus dey among wetin dem collect. 

No comments:

Post a Comment