Friday, 8 September 2017
Dem kick one pregnant mom out of one restaurant because she wear "Weirdo" crop top
One pregnant woman wey her name be Charisha Gobin wey dey expect twin don accuse one restaurant say dem discriminate against her because say her belle dey show.
Gobin yan say for Sunday she wear one black crop top wey get Weirdo for the front with long white skirt go one Buzz Inn Steakhouse wey dey Marysville.
She follow yan say after she sit down, one waitress come meet her recite the resturant dress code for her.
“The waitress/bartender stopped us and said, ‘I’m sorry, you can’t be here in that shirt’,” she explained. “I said, ‘Are you being serious with me right now?’ And she said, ‘Yep, you can’t be here’.”
The waitress yan say the restaurant get “no shoes, no shirt, no service” policy, and say anyone wey wear crop top, whether dem dey pregnant or not dem go ask dem make dem cover up.
Goblin wey be seven and half month pregnant with a boy and girl follow watin the waitress yan and wear shirt wey get sleeves.
“I didn’t even have cleavage showing,” she said. She also said she felt body-shamed because her “belly was bigger and sticking out.”
For one statement wey the restaurant release to apologize, dem yan say:
“Our apologies for the misunderstanding. The server in question has been with our company and a great employee for almost 20 years and was trying to use her best judgement [sic] and by no means was trying to be demeaning to the guest again our sincere apology for misunderstanding”.
Gobin yan say the restaurant don lost one customer as she no fit go there go eat again.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment