Wednesday 20 September 2017

The Lagos state police command yesterday don arrest eight members of one notorious cult group for Lagos Island.



According to one statement from Public relations officer of the command, Olarinde Famous-Cole, he yan say at 6:30 am dem receive call from residents for the area wey yan say unknown thugs dey waka about with dangerous weapon for Evans street, Lagos Island.



After dem receive the information, the Police trail the suspect go their hideout wey dey Federation Hotel for Andrew street Lagos Island.

The names of the suspects wey dem arrest be: Kazeem Kareem 'm' , Belly Akeem 'm' , Ahmed Hassan 'm', Abiodun Hassan 'm', Segun Popoola (a.k.a Playboy) 'm' , Adeyinka Ayodeji 'm', Olanrewaju Sulaiman 'm' and one Sakirat Kareem 'f'.

The suspects don confess say dem be members of 'Eye Confraterbity cult group' and dem believe say Rasak Olalekan Kareem 'm' a.k.a Falapa 25yrs be the gang leader.

According to the police dem go soon charge dem to court, dem kon beg anybody wey get useful information on top the mata make dem contact the Police.

No comments:

Post a Comment